Monday, February 28, 2011

No condition is permanent by African China

INTRO
No call your paddy ole because
no be him create himself
Ma pe paddy e l'ole because
nobody knows tommorow

CHORUS
No take the job wey I dey do dey
laugh
No condition is permanent
Make you no take the job wey I dey
do dey laugh o
Cos all fingers are not equal

VERSE 1 (x2)
If you dey laugh me, you dey laugh
my God
Patient Dog, wait your time dey
come
Food wey person go chop, e no go
pass am o
So no take my job o, begin dey laugh
me

REPEAT CHORUS

VERSE 2
No laugh some people wey be say
e no get
Brother make you no dey vex say
because you no get
If I dey owe debt no be from your
pocket
Wetin dey make you no dey mind
your business
I dey do conductor, no job for
town
I dey drive Okada brother, life
no be yarn
Wetin dey make you no dey mind
your business
So, no take my job o begin dey laugh
me

REPEAT CHORUS

VERSE 3
Oga Landlord, make you no forget
Say one day, you go surely travel
And if you travel, make you no
forget say
Another landlord go dey show
you trouble
Anything you do your fellow man
today [Ah]
Ready for your own tommorow
My brother, wickedness e no dey
pay
Destiny dey delay, but e no dey
change

REPEAT CHORUS

REPEAT VERSE 1

REPEAT VERSE 2

REPEAT CHORUS

Oga Landlord, make you no forget
Say one day, you pickin go travel
And if you travel, make you no
forget say
Another landlord go dey show
you trouble
Anything you do your fellow man
today
Ready for your own tommorow
My brother, wickedness e no dey
pay
Destiny dey delay, but e no dey
change

No comments:

Post a Comment